Jehovah Witness blood donation policy: Jehovah's Witness announce new change to blood transfusion policy for dia members

Wia dis foto come from, DESIREE MARTIN/AFP via Getty Images
Jehovah's Witness say dem don review dia position on di blood transfusion wey concern dia members.
Whole blood transfusion no dey allowed for Jehovah's witness but now e dey allowed to donate or collect parts of di blood from anoda pesin, depending on wetin di pesin conscience fit accept.
Dis dey come from di international tok-tok pesin of di Jehovah's Witnesses, Paul Gillies wey announce am on Friday.
Di governing bodi decision to let dia pipo to accept parts of wetin make di blood wey include red cells, white cells, plasma or platelets.
Dem also address di mata of donating blood say na di 'Witness decision if dem wan donate for di clear purpose of extracting parts of di blood so anoda pesin go fit use am.'
Get smarter about the news
Sign up free for a feed built around what you actually care about, Dive Deeper research on any story, and the full text of every article.
Create free accountAlready have an account? Sign in