Healthy living: Wetin you fit do now to stay healthy for your 70s

Wia dis foto come from, Luis TATO / AFP via Getty Images
From your 30s, small healthy habits fit help you remain strong and active even for your 70s.
Simple tins like taking a quick 15-minute walk evri day, sleeping well regularly, eating balanced food and keeping your body active fit make big difference as you grow older.
By di time you reach your 80s, e dey likely say your body no go dey strong and flexible like bifor, and your brain fit no dey sharp as e be wen you dey young.
Your sleeping pattern fit change too, you go dey feel sleepy for evenings and wake up earlier for morning.
Di one wey fit worry pass be say, based on general health statistics, many pipo for dat age dey deal wit at least one long-term health chronic condition.
Get smarter about the news
Sign up free for a feed built around what you actually care about, Dive Deeper research on any story, and the full text of every article.
Create free accountAlready have an account? Sign in